3 Dia tongue dey wound pipol like snake and dia lips dey bring out snake poizin.
Den Oga God tell di woman. “Wetin bi dis wey yu don do so?” Di woman ansa, “Di snake deceive mi and I kon chop from am.”
Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.
Dia spit bi like wiked snake own; dem bi like kobra wey nor dey hear word;
Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”
Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
Bikos di next morning, e go bi like sey na snake wey get poizin, bite yu.
Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.
Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu. Wi opress odas kon turn from Yu. All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.
God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
Friends dey deceive friends and nobody dey tok trut. Dem don train demsef to dey lie and do bad tins. Dem nor gri turn from sin kom meet God.
Evriday, my enemies dey tok as dem dey plan against mi.
Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.
But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.