2 doz wey dey plan evil for dia heart and dey kause trobol waka.
I dey look for peace; but wen ever I tok about am, na war dem dey give mi.
Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work.
Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.
Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
My God, si as dem dey wait for korna to katch mi; wiked and strong men dey wait to katch mi, even doh I nor sin or do bad tin.
How long una go dey treaten one man? All of una dey kill pipol and una bi like wall wey don break or fence wey get mark wey go soon fall.
Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart, but doz wey like peace, get joy for dia life.
Yes, dia plan dey burn like hot oven. Dia vexnashon dey hot well-well for nite and wen dey break, e go rush kom out like fire.
Na who bi dat wiked pesin for Nineveh wey dey plan against God?