7 E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.