6 Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!
But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”
Yu ask mi sey why I dey kweshon yor wisdom wen I nor know anytin at-all! I dey tok tins wey I nor undastand and mirakles wey too great for mi to know.
My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?
My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
“E get four tins wey dey hard mi well-well to undastand and dem bi:
Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!