Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 139:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 139:2
17 Iomraidhean Croise  

Hagar kon ask ensef, “I don really si di God wey si mi?” So e koll di Oga God wey tok to am, “Di God Wey Dey Si.”


But I know evritin about yu; both di tins wey yu dey do and di place where yu dey go. I know how yu dey plan against mi.


One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”


Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill.


Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.


God know wetin pipol dey tink; E know sey wetin human being dey tink, dey yuzles!


God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.


I know evritin about yu; di tins wey yu dey do, di place wey yu dey go and how yu dey plan against mi.


God Spirit kon dey kontrol mi and E give mi message make I go tell Israel pipol sey: “I know wetin una dey tok and wetin una dey plan to do.


“Na yu I dey tok about before wen I tell my savant wey bi Israel profet sey, ‘For dat day, I go ask somebody make e attack Israel. God wey get pawa don tok.’ ”


Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e bring one small pikin near am


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan