12 e nor get how di darkness dark rish wey Yu nor go fit si mi, bikos nite brite like day for yor eye and darkness and lite na di same tin to Yu.
Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.
Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.
Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.