10 yor hand go guide mi for der and yor rite hand go support mi.
E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.
I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.
Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.
Na mi bi di Oga wey bi una God and I dey enkourage una sey, ‘Make una nor fear, bikos I go help una.’ ”
If dem hide on-top Mount Karmel, I go find and katch dem. If dem hide for bottom sea, I go kommand di wiked animals for sea make e bite dem die.