Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 137:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 As wi sidan near Babilon River, wi kon dey kry bikos wi dey tink about Jerusalem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 137:1
27 Iomraidhean Croise  

For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.


Na for di twelft day for di first mont naim wi komot from Ahava River kon start to go Jerusalem. Awa God dey with us and E protet us from enemies make dem nor attack and set trap for us as wi dey travel.


so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”


I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!


“So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!


“Di short nika wey yu buy and wear so, pul and take am go Perat. Dig and hide am for one hole wey dey di rock near Eufrates River.”


I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.


Una wey dey stay along Babilon river, una end don near well-well. Una wey rish well-well with propaty wey una tif, dis na di time to kill una.


I dey hear my pipol dey kry for evriwhere for di land sey, ‘God nor dey Zion? Abi Zion king nor dey der again?’ ” But God ansa, “Wetin make una go woship juju kon make mi vex?”


Bikos of dis tins; I kry well-well, but nobody dey to konfort or give mi hope. My shidren nor get future, bikos awa enemies don win us.


Jerusalem wall wey fine well-well, make yu kry give God! Both day and nite, make di wota from yor eye dey flow like river! Make yu nor rest or stop to kry!


Wota dey rush kom out from my eye, bikos dem don distroy my pipol finish.


My heart heavy well-well wen I si wetin happen to di wimen for dis town.


Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.


Na God give dis message to mi Ezekiel Buzi pikin, wey bi priest, near Chebar River for Babilon and I feel en hand for my body.)


Den I kon rish Tel-Abib wey dey near Chebar River, for where di prisonas dey stay and I kon stay der for seven days, but di tins wey I si and hear, fear mi well-well.


So I wear sak klot, sidan for ashes den turn to God kon dey beg am as I dey pray and fast.


Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,


I go give my two witness authority to profesai for 1,260 days and na sak klot dem go wear.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan