9 and di moon and star dey rule for nite, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
God make two big lite: di one wey big pass go shine for day time and di small one go shine for nite. God make di stars too.
I neva ever woship sun, bikos e dey give lite or di moon, bikos e fine.
Na Yu get both day and nite; na Yu still make di moon and di sun.
Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”
God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”