Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 136:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make wi tank God wey bi di oga of all gods, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 136:2
8 Iomraidhean Croise  

I go build betta big temple, bikos awa God big and betta pass evry oda gods.


God stand for where en pipol gada put and E from der dey judge di oda gods


But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.


Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.


Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”


Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”


Bikos di Oga una God na God of all gods and Oga of all ogas. Na en bi di great Oga God, di God wey dey do wonders, God wey nor dey do wayo and nobody fit bribe am.


“Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan