Yu do wonderful mirakles against Egypt king, en ofisas and dia pipol, bikos Yu know as dem take opress yor pipol. Yu win and give yorsef name wey dem dey celebrate till today.
Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?