4 True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.
us wey bi en savants, Abraham shidren and wi wey bi Jakob wey E choose, shidren-shidren.
Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.
“But Israel na my savant! Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;
Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. Na God wey get pawa, bi en name.
Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.
Yet God show en love to una grand-grand papa dem. And E choose una wey bi dia grand-shidren above evry oda pipol, as all of us dey si am today.
Today, God don sey una bi en pipol, en betta gift wey E value well-well, just as E promise, so una must obey en kommand.
Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.
E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.
But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.
God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.