Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.
Dis na di kings wey Joshua and Israel pipol win for Jordan River west, from Baal-Gad for Lebanon Valley go rish Mount Halak and Seir. Joshua give dis aria to Israel tribes,