11 Sihon wey bi Amor pipol king and King Og for Bashan and all di kingdom for Kanaan,
Yu make dem win nashons, kingdoms and lands wey dey near dia own. Dem win Heshbon land, wey Sihon dey rule and Bashan land wey Og for bi king.
But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.
“Wen wi rish here, King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan kom fight us, but wi win dem.
I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow.