3 Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion!
God go make yor kingdom big and strong for Jerusalem and yu go rule ova yor enemies.
Make God wey make heaven and eart, bless una.
God wey kreate heaven and eart, na-im diliver us from dia hand.
Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.
E good make evribody for Zion, praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem, make all of us, praiz am!
Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
Make E kom help yu from en temple, den give yu pawa from Jerusalem.
Make E remember all di gifts wey yu gi-am, den favor yu, bikos of yor ofrins.
Dis na God message about Israel. Na God kreate di sky and di eart kon give life to man. God sey,
Na so God go save all Israel pipol just as en word sey: “Di pesin wey go save Israel pipol go kom from Zion, den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.
For dat time, Boaz kom Betlehem kon greet di workers sey, “Make God dey with una!” Dem ansa, “Make God bless yu too!”