Dem karry am komot from Abinadab house for di hill kon go put am for one new truck wey melu dey draw. Uzza and Ahio, wey Abinadab born, na dem dey guide di truck.
But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
Naw, David na one Efrat man pikin and di man kom from Betlehem for Judah and en name na Jesse. Di man get eight boys and wen Saul dey rule, di man don old well-well.
Den, Kiriat-Jearim pipol kom karry di Kovenant Box go Abinadab house wey dey di hill. Dem kon santify Abinadab pikin, Eleazar, so dat e go dey guide di box.