My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.