Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 132:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 132:14
21 Iomraidhean Croise  

Naw! I don build big temple for Yu, place wey Yu fit stay forever.”


My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?


God tell am, “I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always.


Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.


My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey, with di Kovenant Box wey dey show yor pawa.


E good make evribody for Zion, praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem, make all of us, praiz am!


Yu mountin wey get many top, why yu dey jealous di mountin wey God won stay? True-true, God go stay der forever.


God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!


Na Jerusalem E dey stay and na Mount Zion bi en house.


God love Jerusalem pass any oda town for Israel.


Di day dey kom wen di new king from David family go bi sign to all di nashons. Pipol go gada for en royal town; gi-am respet kon ask make e guide dem.


Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.


My pipol wey I neva forgive before, I go forgive dem and mi wey bi Oga God go stay for Jerusalem with my pipol.”


Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’


And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear.


thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.


Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly,


Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan