1 My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa.
But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.
Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.
I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?
I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.
Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.
My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart.
My God, my heart nor dey proud; my eyes nor dey look anyhow. I nor dey worry mysef with matter wey too heavy for mi to bear.
Make Yu feel my pains kon si my trobol, den Yu go forgive mi all my sins.
God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob.
Wen ever I remember as I take sofa without house to sleep, e dey pain mi like poizin for my belle.
Awa God, make Yu tink about dis tins wey dey happen to us naw and how awa enemies don disgrace us rish.