Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 131:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, my heart nor dey proud; my eyes nor dey look anyhow. I nor dey worry mysef with matter wey too heavy for mi to bear.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 131:1
26 Iomraidhean Croise  

and I go disgrace mysef pass like dis. Yu fit tink sey I fool mysef for pipol front, but doz girls go respet mi more-more!”


Yu ask mi sey why I dey kweshon yor wisdom wen I nor know anytin at-all! I dey tok tins wey I nor undastand and mirakles wey too great for mi to know.


I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.


I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”


Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”


Make una si as e dey good and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace!


Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!


Na pride dey kontrol wiked pipol and anytin wey kom out from dem, na sin e bi.


But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.


Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”


(Naw, na Moses honbol pass anybody wey dey di eart.)


Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.


how I nor dey karry body up as I dey serve Jesus with pain and wahala wey I dey face, bikos of di wiked plan wey Jew pipol get for mi.


Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!


Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.


As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.


As wi dey live with una wey bilive Christ, una and God na awa witness sey, wi dey holy and dey do good tins for God eye without fault.


So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.


One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”


Den Saul send pipol go tell Jesse sey, “Make David bi my savant, bikos I like am.”


David dey go kom back from Saul palis, so dat e go fit take kare of en papa sheep for Betlehem.


So Saul savant go tell David wetin di king tell am make e do. David ansa, “Na betta honor to marry di king pikin. Di honor too mush for pesin like mi wey nor bi anytin!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan