1 My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart.
I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?
I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.
Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.
E kom down from heaven kon save mi, den E drag mi kom out from deep wota.
E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka.
I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.