6 Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.
So my soul go rest again, bikos God dey good to mi.
As I dey learn evritin about yor raitiousness, I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am!
My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.
Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.
Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.