Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 123:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 123:4
16 Iomraidhean Croise  

Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”


Yu nor get trobol, but yu still dey laf mi; pesin wey won fall before, yu don kuku nak am make e for kwik-kwik fall.


If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu.


Na so-so laf wiked pipol dey laf mi, yet, I dey still obey yor laws.


Una dey enjoy life since and nor kare about anytin, but naw, make una shake dey fear! Make una pul una klot kon tie rag for una waist.


Wimen wey dey enjoy life, make una listin to wetin I dey tok! Di wimen wey get heart well-well and nor kare about anytin, make una listin to mi:


God sey, “Moab pipol dey always stay for peace and dem neva ever karry dem go do slave work. Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun; wine wey dem nor dey pour from cup to cup. Yes! Di wine still sweet and en taste still good as e bi before.


Moab pipol, hope una remember how una take laf Israel pipol? Una trit dem like sey dem bi tif.


Moab pipol too dey proud! I don hear as dem proud and sturbon rish and how dem dey tink of demsef alone.


E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion and una wey feel sey una dey save for Samaria. Una tink sey na una strong pass, bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.


(Atens pipol and odas wey dey der, nor get any oda work pass make dem sidan dey tok story about any new tin wey dey happen.)


Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, some kon dey laf, but odas sey, “Yu go tell us dis matter again.”


As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!”


Wen pesin curse us, wi nor dey ansa back with kworel. So till today, dem dey si us as dirty for dis world.


Wen di Filistia man near David, e kon vex well-well, bikos na small and fine boy e bi.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan