19 Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.
So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.
Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.
As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.
Make una open di town gates, so dat di nashon wey dey faithful; wey en pipol dey do wetin dey rite, go fit enter.
So Oga God, Yu don heal mi. I go play harp to take sing and praiz Yu; I go sing praiz for yor temple as long as I dey alive.”
Den King Hezekaya ask, “Wetin bi di sign to show sey I go fit go di temple again?”
God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.