10 Wiked nashons gada around mi, but I distroy all of dem with God pawa.
Yu put my leg for dia neck and I don distroy evribody wey hate mi.
Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom. Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.
Evriday, pipol gada round mi like wota kon join togeda dey opress mi.
Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
But wen dat time rish, I go make Jerusalem bi like rock wey nobody fit move and all di nashons go gada togeda kon try to move am, but dem go just dey wound diasef.”
All dis kings gada for Merom River side, bikos dem won fight Israel pipol.