1 Make all di nashons praiz God. Make all di pipol for di eart praiz am.
Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!
Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!
Evritin for eart go woship Yu; dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory as dem dey koll yor name.”
My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
Oga God, all di nashons wey Yu make, go kom bow down for Yu and dem go praiz yor holy name,
Dem rite am for God word sey, “Una wey bi Gentile pipol, make una praiz God. Make evribody praiz am.”
Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”
Dem kon dey sing new song sey: “Yu holy rish to take di book kon open di keys, bikos dem kill yu and na yor blood save all God pipol from evry tribe, language, group and kountry.