2 E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi,
God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?
I go praiz God, bikos E don hear my kry for help!
Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi. Make Yu bi my rock wey go dey protet mi; di strong place where I fit hide put.
Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.
I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry.
My Oga God wey dey save mi. For day time, I dey kry give Yu and I still dey pray to Yu for nite.
Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray.