9 So, Israel pipol, make una trust God, bikos na-im dey help and guide una.
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
So Israel pipol, make una put una hope for God hand, bikos God dey show en love and E always dey ready to save en pipol.
Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.
Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.
“Evritin wey God tok, dey korrect. E dey guide evribody wey kom meet am make E protet dem.
Di juju dey yuzles, so make dem distroy dem trowey and time dey kom wen God go ponish and distroy all of dem.
so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.
Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”