Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 113:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 113:4
10 Iomraidhean Croise  

My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?


Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven!


Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens.


Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.


God dey great for Zion and naim bi Oga ova all di nashons.


Si, di nashons nor mean anytin to God, dem bi like one drop of wota. Di island wey dey for far nor heavy rish dust for God hand.


All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan