Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 112:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 112:7
20 Iomraidhean Croise  

Na dat time yu go fit face di world without fear and yu go dey innocent.


God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?


I pray to God and E ansa mi kon free mi from all my fear.


Dem bilive dia money kon dey boast with all di tins wey dem get.


My God, I get hope. Yes! I get hope. So I go sing kon praiz yor name.


My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.


Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.


But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.


Shadrak, Meshak and Abednego ansa King Nebukadnezzar, “Wi nor fit ansa yu for dis matter.


So, if una stand rish di end, God go save una.”


And wen una hear rumor about war and wahala, make una nor fear. Bikos all dis tins go first happen, but dat nor mean sey di end don rish.”


“Make una nor let anytin worry una mind. Since una bilive God, make una still bilive mi.


But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.


But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”


So, my pipol, make una heart strong, bikos I bilive sey na as God tell mi, na so e go bi.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan