Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 112:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 112:5
22 Iomraidhean Croise  

So I give di pipol swod, bow and arrow kon put some pipol for back of di walls and some for open space.


Wen wiked pipol borrow sometin, dem nor dey pay back, but doz wey dey fear God dey give tins to pipol with happiness.


God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.


Na only pesin wey nor get sense go promise to pay anoda pesin debt.


Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.


So, make yu follow wetin good pipol dey do, so dat yu go fit live betta life.


Before yu build yor house, make sure sey yu don prepare and ready yor farm for work.


E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.


But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.


Wen evribody don beleful, Jesus kon tell en disciples, “Make una gada wetin remain, make anytin nor waste.”


Banabas na betta pesin, di Holy Spirit dey inside am and e get faith well-well, so many pipol kon bigin follow Jesus Christ.


Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.


Nobody go won die for anoda pesin wey dey good for God eye, aldo somebody go fit die for pesin wey good well-well.


Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.


I pray make una love dey strong more-more for God tins wey una learn and make E help una undastand,


Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan