10 Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.
But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.
but God go blow all of dem trowey like dust. Pipol wey know dem before go sopraiz kon ask, ‘Where dem go?’
Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.
Wiked pipol dey plan against God pipol; dem dey attack God pipol anyhow.
Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi. Den shame go katch di pipol wey hate mi, bikos Yu wey bi my God, don help and konfort mi.
Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.
Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.
“Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”
“Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside.