1 Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
So Ahab koll Obadaya wey dey kare for di palis. Obadaya dey serve God with all en mind.
Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
Even doh pressure and wahala dey make mi taya, yor kommand still dey make mi happy.
I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
Make Yu let mi follow yor kommand, bikos na der my happiness dey.
My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.
Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.
Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass.
All of una wey dey respet God and obey en savant words, di road wey una dey waka fit dey dark, but make una trust una Oga God! Make una put hope for una God.
E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.
I dey like to obey God law with my whole mind,
If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.
God go bless una towns and una fields.