3 Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
Bikos God don promote am make e dey en rite hand and e don receive di Holy Spirit wey en Papa promise and naw, e don pour di Holy Spirit for awa body, as una si am dey happen so.
True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.
make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand