Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart. Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong. I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
Pipol wey I koll my own don turn against mi like lion for forest; di way dem dey tok to mi, bi like wen lion dey shaut. So I go trit dem like sey I hate dem.
My God wey dey mighty; Yu dey give korrect judgement to pipol and Yu know wetin dey dia heart and mind. So, make I si how Yu won take revensh my enemies, bikos I don put my problem for yor hand.
I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”
E go kom judge like pesin wey dey wosh and klean silva and gold. Just as pesin wey dey wosh gold and silva so dat dem go klean, na so too, God messenja go wosh di priests, so dat dem go bring betta sakrifice kom give God.
Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.