Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 109:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 109:7
9 Iomraidhean Croise  

God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers.


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.


Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan