21 My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.
My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.
Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.
Yor love wey nor dey fail betta pass life; so I go praiz Yu!
My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!
Dem dey opress and sofa mi! So my God, make Yu diliver and protet mi!
But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol; Yu nor dey kwik vex and Yu dey show yor faithfulnes and great love wey nor dey fail.
Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.
Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.