(Dis Judas buy one land with di money wey e kollect for di wiked tin wey e do and na der e hang ensef till en belle burst and all en intestine kon skata kom out,
So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.