Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.
So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.
Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.