3 My God, for evribody present, I go tank Yu. I go sing yor praiz among di nashons.
Make all di nashons praiz God. Make all di pipol for di eart praiz am.
I go tok about yor name for where my kountry pipol dey. I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
Di whole eart go know God kon run go meet am. Evribody for di world go bow woship am.
Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!” Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am. God go judge evribody akordin to wetin dem do.
Una wey dey Zion, make una shaut! Israel pipol, make una shaut too! Jerusalem pipol, make una dey happy and boast with all una heart!
For dat time, I go gada and bring una kom back to una house. Wen I dey give una evritin wey una don lost before, I go make evribody for dis world respet and honor una.” Mi, Oga God, don tok.