Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.
Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.