7 Wen Yu kommand, wota dey vanish and wen Yu shaut, e dey bi like tonda and di wota dey kwik-kwik rush komot.
But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.
E kommand di Red Sea make e dry kon take Israel pipol cross am like sey na desert
Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.
Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.
I still dey wen E put di kloud for sky; open di wota for di sea
So Jesus get up kon kommand di breeze, den e tell di river, “Make yu kwayet!” Di breeze stop and evriwhere kon kwayet at wons.