Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 104:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Yu build di world on-top strong foundashon, so dat nobody go fit remove am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 104:5
14 Iomraidhean Croise  

God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.


Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart, e still dey kon rish naw.


Di Pesin wey put di eart on-top wota, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


E build di eart foundashon on-top sea kon make am stand on-top wota.


Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.


God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.


Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!” Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am. God go judge evribody akordin to wetin dem do.


kon orda sey make di wota wey dey di sea nor full pass as E kommand am. I dey der wen God lay di eart foundashon.


Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go, but di world nor dey shange.


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


Di sky kon dey fold like paper and evry mountin and island move komot from where dem dey before.


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan