10 Yu turn springs to rivers and dem even dey flow between mountins.
But for en pipol, E turn desert to where wota full and dry land to where wota dey flow pass,
di hot groun go turn to lake and wota go kover all di dry land. Where wiked dogs bin dey stay, grass, reeds and straw go grow full der.
I go make river flow from dry hill and wota go flow for valley. I go turn di desert and di dry land to where wota full.
Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill.