9 E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem.
Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.
No, but God vex for en pipol kon send dem go Babilon as dia ponishment. E karry dem komot from dia land with one strong breeze from di east.
I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.
God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.
Yu go vex and forget us forever?’ All dis na wetin una dey tok, but una still dey do di bad-bad tins wey dey una mind.”
I go forgive en sins and e go get di life wey nor dey end, bikos e don do wetin dey rite and good.