Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 103:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 103:18
19 Iomraidhean Croise  

Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.


Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.”


All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.


And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.


So Moses take di blood and e sprinkol am for di pipol body kon sey, “Dis na di kovenant blood wey God don make with una akordin to dis word.”


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


Nobody don si or hear about any oda god wey bi like Yu or di one wey fit do di kind tins wey Yu dey do for doz wey put dia hope on Yu.


Like dat, una go remember and obey my kommand kon dey holy to una God.


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


Na bikos of dis I dey always try my best to get klean belle for God and pipol front.


So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.


If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.


So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.


Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan