16 Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
Enoch waka with God, den e vanish, bikos God take am.
But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?
Pipol wey si dem before, nor go si dem again. Dia family nor go si dem again
One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!” So I ask, “Wish message I go prish?” Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass; let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.
Grass dey dry and flowers dey fade wons God send strong breeze go blow dem. Na so too pipol nor dey last pass grass.