14 Bikos E know how E take kreate us kon remember sey na dust wi bi.
So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”
Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again?
Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight? Abi na dry leaf Yu won porshu?
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
Dem dey turn evritin up-side-down. Wish one dey important pass: di pesin wey dey mold di klay or di klay? Wetin pesin make fit ask am, “Na yu make mi?” Abi di pot fit tell who dey make am sey, “Yu know wetin yu dey do so?”