Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 103:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 103:12
14 Iomraidhean Croise  

So David sey, “I don sin against God.” Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die.


Pipol go praiz God name from east go rish west.


Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.


Di pain wey I go thru na for my own good. Yu save my life from all di wahala kon forgive mi my sins.


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”


I do dis tins make evribody for di world, from one end go rish di oda, know sey na mi bi God and e nor get anoda god wey bi like mi.


“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”


Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”


God go forgi-am all en sin and e go get life, bikos e do di rite tin.”


E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.


Yes! Yu go sorry for yor pipol. Awa sins go dey under yor leg and Yu go trow dem go under di sea!


If pipol wey dey woship God don free from dia sins, dem nor for dey offa sakrifice again.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan