Even afta di ponishment wey don happen to us bikos of awa sin, wi still know sey Yu, awa God, dey sorry for us, bikos even doh Yu dey ponish us, Yu still help us survive am.
My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.